LOVE POEM#8, E Love mi?

E love mi?

 

Babi too laik fine fine thing

Christain Dior

And so so Versace

She say she laik to hold dem waka

To wear dem waka.

I ask if she laik dem

She say dem don pai

Na her sef she laik

 

 

Babi too laik fine fine man

From Nasarrawa

From Ekot Ekpeme

She say she even laik me

Dey hold me dey waka

I ask if she love mi

She come laugh mi, I shy.

Na her self she love


Leave a Reply