LOVE POEM#7. Lip Stick Pregnancy
Lip stick Pregnancy
Her lip stick dey bright
Mai throat come enta
I kiss am sotey
Lip stick finis for im lips
She rub am again
I kiss am comot
She tell me say I go buy market
I reach haus refuse eba
You chop outside?
I say yes mama.
Wetin you chop?
Palm oil stew
E belleful you?
Yes o. I don get belle.

Very cute!