love poem#22. Make I ring?

Write or ring?Make I ring?

Abi make I ring

to say I love her

Abi make I write?

The love too much

Na twenty chapters

If dem weigh am

Na money o!

The love talk plenti

If I come start

The yarn tey pas mai credit

I don sabi

Go marry put haus

Face to face, free of charge

I go dey tell am

Say I love am

SIX MONTHS LATER

Abi make I return

that ring for im finger

I never pay finis

and she don dey rude

I come see say

To write love letter

Na im sweet pass

To love for phone

Na im good pass

To live with perfumed trouble

Face to face

To live with well dressed yawa

Face to face

E too cost!

All mai peace don finis

Dr Wilson Orhiunu. (Babawilly). July 2007


One Response to “love poem#22. Make I ring?”

  1. Again, clever.
    Hmmm, dejavu perhaps?

Leave a Reply