LOVE POEM #17. Text Message
Text Message
I see text Begin dey cry for office
Everyone console
Dey fear to ask wetin dey
I pull tie
Nak head for laptop
Scatter all mai byah byah
Throway all di files
Manager come console
Director sef come
Dem dey take eye ask each other
Wetin do dis man sef
Na im I show dem text
‘Darling, have missed my period’
All of dem start to cry too
As na fourteen pickin I get!
Dr Wilson Orhiunu
June 2007

Like the suspense until the very end… clever!