LOVE POEM #16. Family planning

Family Planning?

I kiss am E fall for ground

Say make I carry am go room

She say mai tongue bi laik

A million jars of honey

The last time na so

She born nine months later

Na im I knell down dey beg

As condom no dey mai pocket

For pill she no takeTube she no tieCoil e no gree

I don taya no bi smol

I knell down beg again

Mai fourteen pickin follow beg

If I carry enta dat room

Na tomorrow we go comot

The pickin cry

Wetin dem go chop

Even me play wayo

I say mai back dey ache

She juss smile cuni smile

Pull me close with im finger

For pill she no takeTube she no tieCoil e no gree

I don taya no bi smol

I carry am for shoulder

Bi laik work go soon resume

Pickin celebrate

Dem do watch TV till dawn

We lock door, put loud music

Mai backache disappear

Na middle of month she dey

Nine months time, I pray no bi twins

For Pill she no takeTube she no tieCoil she no gree

I don taya no bi smol

Dr Wilson Orhiunu

June 2007


One Response to “LOVE POEM #16. Family planning”

  1. Hmmm, nuff said. Great piece, I like!

Leave a Reply