LOVE POEM #15. Na who
Na who?Na who dey come so?
Balance for back of limousine
Denge laik a million dollars
Look! My Omote
Im bridesmaids surround am
Dem don comot moto
Hold umbrella for mai Omote
Sun no go beat im bodi
Dis skin wey bi laik
Angels polish am all nait
Coral beads set for her neck
Im Papa try
but I go buy more,
sotey she no fit wear dem.
Na museum she go keep am
My Onome,
im bodi dey upholstered with honey
Na dis one I go marry today
She wear crown dey come
People dey ask
Na who dey come so?
Who dey come,
On dis day wey I go marry
On dis day
Wey mai belle sweet mi pass.
(Inspired by Song of Solomon. Chapter 3 Verses 6 – 11 & Fantasy)
Dr Wilson Orhiunu
June 2007

Another master piece. You weren’t lying when you said Songs of Solomon gets you in trouble. Well keep this up and you sure will get in trouble. Good one though!